Deriv Review

Deriv na international broker wey millions of people don register with all around the world, dem dey offer CFDs on top Forex, indices, cryptos, and commodities. But, plenty online platforms dey rate them bad, and people wey don use their service complain say e no good. Dem say e hard to withdraw money from them, and this na major red flag. Surprise surprise, even though dem start since 2019, dem never still manage to provide beta trading conditions. To give una full review, make we check inside the services and conditions wey Deriv dey give. The broker dey regulated by the Labuan Financial Services Authority, the Vanuatu Financial Services Commission, and the British Virgin Islands Financial Services Commission. Make una know say these offshore regulators no dey protect una money pass how other better authorities go do am. Deriv dey use separate bank accounts and dem participate for the investor compensation fund. If you pay money for your account, you go see the alert instantly but when you wan comot your money, e fit take up to 1 working day, but the website no talk if you go pay money for am. If you want commot your crypto, Dem go check am well well before dem approve am. How you go pay your money? you fit use wire transfers, bank cards, o online payments, Deriv P2P payment system, or cryptos. But based on as people complain wella about withdrawing money, we go reach out to dem for customer support make dem explain. E important say you use the same payment option you pay with when you want withdraw. If the payment option you use when you pay no dey available for withdraw, e go cause problem and your money go delay. You suppose hear this solid information before you open account with Deriv.
Countries
Afghanistan, Albania, Algeria, Andorra +156 more
Regulations
FSA Labuan, FSC of BVI, VFSC
Account currencies
AUD, EUR, GBP, USD
Assets
CFDs on Stocks, Crypto CFDs, ETFs, Energies, Options, Precious metals, Synthetic Indices, Volatility 75 Index
Platforms
MT5, Custom
Deposit methods
Bank Transfer, Credit Card, Crypto, E-wallets, PayTrust88
Others
Segregated accounts, Copy trading, Demo account, Exotic Pairs, Expert Advisors, Fast withdrawals, High leverage, Lowest minimum deposit, Micro Lots, Negative balance protection, Part of compensation scheme, Swap-free
Promos
Visit broker
To see the different types of Deriv account, sharp sharp na wahala. After we make contact with Dem, we get limited information. The only way you go fit view the different accounts na if you open demo account but e go hard to compare the accounts. The information dem give us only carry the account names, levers, and trading instruments dem get. But the customer care try try to help us sha, but we still think say e important for the broker to explain everything for their website so that people no go dey always try find the information. Deriv get three different types of account: Derived, Financial, and Deriv X. All three accounts na 1:1000 be their highest leverage. For the Derived and Financial accounts, Dem dey use MT5 to trade. But Dem give for the Deriv X account one special platform called Deriv X. Deriv still get plenty trading bots like Deriv Bot and Binary Bot. Deriv platforms dey support trading of Forex pairs, options, and CFDs. But you go do option trade only with the Deriv X platform, the CFDs dey available for trade on top MT5, for there you go see forex, stock CFDs, indices, commodities, and cryptos. If you dey travel, Deriv Go na mobile app the broker give people make dem fit trade. You suppose reason well well if you choose Deriv as your broker. Firstly, dem no dey give detail about their trading accounts, minimum deposits, and other important information. Also, dem no talk as e go cost to withdraw money and how e go be for general. Plus, traders don rate them bad. But we no talk say na scam them be, dem still fit improve well well.

FAQs about Deriv

I fit trade forex with Deriv?

Deriv dey offer Forex pairs for their trade platforms. People fit trade forex for both desktop and mobile apps, and dem get all the major and exotic pairs. The only kasala na say no too clear information dey their website about the platform wey dem take trade.

I fit trade with 1 dollar for Deriv?

Deriv no give clear information about their minimum initial deposit. E better make you no use this broker as many things no dey cool about them.

For which countries Deriv wan make dem no trade?

Deriv get licenses for several places, because of this dem no allow dem to offer their services for other places like USA, England, Australia, Japan, and other countries. Make you no near this broker.